APROKOooSPECIAL🗣️🗣️📢📢
with SistaQ✨

🔥🍗😁🔥🍗 TodayTurkey🔥🍗😁🔥🍗

Still on some MONEY 💵💸Vs FAMILY👨‍👩‍👧‍👦 mata

E no easy to born, train and take care of pikin till the pikin fit take care of him/herself reach where im suppose start to dey take care of im parents.

For this reason; e get people wey believe say na disrespect and abomination to borrow money to your parents.

Meaning say, if your parents need money and them ask you, make sure say the money wey you dey give them na wetin you fit dash them.
Say no matter what happens, even if your parents ask you to borrow them money, as a responsible son or daughter wey truly love im parents...
No gree...YOU MUST DASH THEM!

But if na money wey too big to dash out, some prefer to talk say them no get, than to say them go borrow money to their parents.

Say na abomination to say you dey ask your parents to pay debt of money wey them dey owe you.

You believe say no big deal dey to borrow money to your parents? You dey find am easy or normal to ask your parents to pay back money wey you give dem?

Abi

You believe say e no make sense to LOAN money to your parents rather you must dash them?

If na money wey pass you nko?

How you reason this matter 🤔
Turkey dey your front 🍗🍗🍗
Collect your share 😁

image